EnterTaME

Get ENTERTAINED! An escape from Stress!

Monday, August 12, 2013

THE REVENGE OF THE RAT.

Recall this....?
RAT WALL POST FaceBook:
Omo na die I dey oh..... No food for my master kitchen. Na him books go hear am nah. Him think say I come him house to watch TV abi?
COMMENT:
Your master stingy, disown am jor.


Ratus ratus was still furious when he placed this call to house owner (man):
Rat: (with tiny voice) hello.
Man: hello, who am i speaking wit?
Rat: na Mr John be dis abi?
Man: yes u are speaking wit Mr John, who is dis pls?
Rat: so u no recognize my voice abi? Na me ur room mate.
Man: u say what?.
Rat: ur room mate "Rat". I dey ur room now..
Man: i beg ur pardon?
Rat: which yeye beg u dey beg. i never chop since yesterday wey u waka comot. I check that place wey u dey put food i no see anything. I check d kitchen nothing. I even check ur fridge no single food there. E be like say u
wan kili me abi.. No problem, i jux say make I let u know say that ur CERFITICATE for inside your
wardrobe wey dem write LAGOS STATE
UNIVERSITY i don eat d "LA" comot. Remaining "GOS" STATE UNIVERSITY.
Let me see which work u go take "GOS" state university find.
...(rat ends call)

THE REVENGE OF THE RAT.
mobile email...

No comments: